Tuesday, May 29, 2007

Bounced in the Club AAGAIN!!

Na wetin I do this people ehn? When them just dey treat me like this? i no know wetin I do all these Eko bouncers. E be like say them hold meeting with my picture say make them no dey allow me inside club oh. Omo boy wan go groove na so them just shoo me off say i be under aged. Under gini? old man like me wey go soon clock 25yrs. I know i look 18 or thereabout. For crying out loud that is why I leave the moustache/beards(even though say them no plenty).So it was friday and we went to see the premiere of Pirates of the carribean III. And i enjoyed every bit of it even though we kinda got there a late thank God say the film long well well. Around midnite the movie ended we decided to hit the club. We went to soul lounge first. But me i no gree make we enter because all the time wey i dey go there them never ever allow me enter. them go talk say na for the Matured. Can you imagine that. the last time nah my apkola shoe i been wan take stone the boucer but i come remember say God no give me body like am. Na beat them for beat me that day. So I caome tell my pips say make we opt for another place. The next club wey we go, as your sincerely was about to enter, see the gigantic hand wey push me go back ehn. I no believe am. AB and him chick don already enter, my cousin don already enter na only me remain. Shwo see me see trouble oh. AB yarn the bouncer tire. The bobos refused to bulge. I wan vex die(When no be La Casa). This is the umpteenth time this was happenin to me. I just tell Ab say make him shun the guys. We moved on searching for greener patures. The next Club wey we reach, Na so i just bone up dey form answering phone call. Enter the thing jare. Ol Boy I wan groove die that that i dance till 4:30. i no fit believe am. AB pratically had to drag me out. But come i think i know what I am gonna do to these bouncers. make una no worry i go tell una later