Friday, February 09, 2007

Bimby you sure are a darl

Ol girl, you too much, Na you biko as my Naija Delta bros go talk;Nothing do you,Thanks a MILLION. you just saved me months and months of research. You try too. But the truth be say i neva try am oh. But as you don give me the details I know say e don finish.

Can you believe I havent been able to sign into my blogger, I suspect that witch in my village is doing me lol. But true talk; for the past days i have been try to sign in. The thing no bulge. I just sign in find out say some body don steal the chick wey i dey eye since. No wahala sha God dey. I no go talk pass that one. The guy get lyrics pass me so the chick trip for am. I no know wetin dey do me today wey be say na broken dey enter my head. Anyway nothing much to gist about. As this na friday nite e be like say boys go enter VI go jolloficate, groove till morning after the bad things wey happen to me this week. person bin dey ask me say why my post dey short like this. Dem no know say me i no like talk long talk.Na straight to the point be my theory. Na jealousy go kill me this week. I come find out say some people wey just sign into blogger new, don get plenty visit pass me wey since. I come dey beef them. Wetin I dey beef dem for now? I no know I just know say I dey beef them.

I still dey cry oh! dem don carry her gooo

1 Comments:

Blogger chidi said...

lol!!!!!!!!!!!!!!!!!

7:31 AM  

Post a Comment

<< Home