Monday, April 23, 2007

Post Elections...

I know say i dey always complain say work, work work, no dey allow me post again. no be only that one self the thing wey no dey allow bobo post don too much. my computer self no come dey help matter. Evry time to sign into blogsville na war. I go refresh, refresh page tire. Any way that wan nah old gist.

Blogville una well don oh make una no vex say i no dey post. Some correct correct blogger dey inside this blogsville Oh, Prince olu, naija fine boy. i dey feel una. You guys crack me up each time i visit. Na wah oh, I no know where i dey when God dey share out sense of humor. Even to make small pikin smile self i no fit.

Elections don come ,go. God don disgrace all those false prophet wey dey prophesy say Naija go burn for this election, Say civil war go break out, say election no go hold..Shame on top all of Una. We don vote finish people wey don win don win, people wey don rig don rig. We dey wai for MAY so that new government go start. The thing we dey pain me be say all those public holiday wey we dey enjoy don finish. But come Oh, this month gather public holiday like say tomorrow no dey; Sallah oh, easter oh, election oh, Obasanjo-atiku holiday oh Gbogbo eh (I say i must talk yoruba by force). For VGC the people host INEC officials till 9'o clock(True oh no be lie) abeg all my VGC people make una back me up make them no feel say na lie i dey lie. See Effizi oh. nah so them organize queueing card for all Voters. Wetin remain nah make them buy food for every body wey come vote. The park was so alive on saturday I was impressed by the number of people that turned out to perform their civic responsibility. Me think say all man go dey form Big Man for house. For where na them dey do all the organisation and every thing. INEC people just sit down dey look. But come oh. I no know say Beautiful Chikalas dey this VGC like that ooh. EHn! Them plenty that day . Boys gat to dey use distinguishing factor know the ones wey dey available and those wey no dey. That one nah my small secret. But upon all the ones wey i see i no fit catch any one. No wahala sha. the thing wey make me happy be say this weekend I been hang with some of my Cuzins. Eh don tay wey I see these my cuzin. I no know say OV don tall pass me. See me see trouble oh. this small boy wey I dey carry if him cry those days, Now wen i wan talk to am I must raise up my head. I no come know where he get bass voice from. For our whole family we no get Bass voice. Na wah oh, we come see one movie. I been wan shak the guy up but I no wan make Ov reach house come dey perform ragga for him papa front.